Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 52:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 For di tent day for di fift mont for di nineteent year wey King Nebukadnezzar don dey rule, Nebuzaradan wey bi di king advise and dey kommand di sojas, enter Jerusalem.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 52:12
16 Iomraidhean Croise  

Naw, Midian pipol kon sell Josef for Egypt to Potifa, wey bi offisa to Fero and naim dey kaptain di guide dem.


King Jehoiashin for Judah with en mama, en savants, ofisas and all en kourt workers and priests kon surenda to King Nebukadnezzar. For eight years wen King Nebukadnezzar dey rule for Babilon, e kon put Jehoiashin for prison.


For di sevent day for di fift mont and di nineteent year wey King Nebukadnezzar dey rule, Nebuzaradan, wey bi Babilon sojas oga kon enter Jerusalem.


But bikos awa grand-grand papa dem make God for heaven vex, E kon allow King Nebukadnezzar for Babilon, wey dey rule Kaldean kingdom, attack and distroy di temple kon karry di pipol go Babilon as prisonas.


so I tell di king, “My king, make yu live forever! Wetin nor go make my face look like who dey sick wen e bi sey dem skata and burn di gates for di town where dem beri my grand-grand papa put.”


My God, strenjas don take di land wey Yu choose as yor own. Dem don spoil yor holy temple kon turn Jerusalem to where dem dey pour dirty put.


God still tok to am, wen Josaya pikin, Jehoiakim dey rule for Judah. Afta dat time, God still tok to am until di fift mont for di elevent year wen Zedekaya wey Josaya born, dey rule for Judah and na dat same year, dem katch and karry Jerusalem pipol go Babilon.


and burn am rish groun. Dem go burn am with di house where pipol for don make mi vex, bikos dem dey burn incense give Baal juju on-top di house and dey pour wine as ofrin give oda gods.


But King Nebukadnezzar kommand Nebuzaradan wey bi di sojas oga sey make e go find Jeremaya kom.


Den Nebuzaradan, wey dey kommand di sojas kon karry di pipol wey remain for di town and di ones wey nor strong, go Babilon as prisonas.


and en sojas kon skata di town wall.


Den for en eighteent year for di throne, e karry eight hundred and thirty-two pipol from Jerusalem.


For di third year wey King Jehoiakim dey rule for Judah, King Nebukadnezzar for Babilon kon attack Jerusalem.


Den, Daniel go meet Ariok wey dey kommand di king bodyguard and na-im won kill dem. So e tok to am with wisdom.


“Di fasting wey Judah pipol dey do for di fourt, fift, sevent and tent mont, go kon bi festival for joy and for betta tins. Una must love trut and peace.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan