Naw, mi, God promise sey, “King Zedekaya with en ofisas and doz wey survive di war, di honga and diziz, I go give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and to dia enemies wey won kill dem. King Nebukadnezzar go kill dem with swod and e nor go pity or sorry for dem at-all.” ’ ”
E distroy en temple like sey na vineyard kon skata where wi for dey woship am. God make Zion pipol forget dia festival and Sabat Day. Naw, kings and priests don fall, bikos E dey vex.
Den I go trow my net on-top am kon katch am with my trap. I go take am go Babilon wey bi Kaldea pipol land (but e nor go si am) and na der e go for die.
Dem go attack yu from nort with many sojas and shariot. Dem wear shield and helmet for head and dem go gada round yu. I go give yu to dem and dem go judge yu with dia own law.