kon go sidan for anoda side wey far from where e put di pikin; bikos e tok for en mind sey, “I nor go fit dey look am until e die.” So Hagar kon sidan far from di pikin as e dey kry.
Dem kill all Zedekaya sons for Zedekaya present. So Babilon king sey make dem pul Zedekaya eyes komot kon shain am with bronze shain, den karry am go Babilon.
God sey, “Make yu rite dis man name as pesin wey nor get pikin and wey nor go ever susid for life. En shidren nor go ever rule for David throne for Judah again.”
Make una kill both old and yong pipol; weda na papa, mama or pikin. But make una nor tosh anybody wey get di mark for en head. Make una start from my temple.” So dem kon start with di leaders wey dey der.