So, wahala go kom meet yu and yor majik nor go fit help yu. Wahala wey yu nor espect, go happen to yu at wons! Even trobol wey yu nor tink of, go rush kom meet yu like wota.
“Make yu go tell di nashons di good news! Tell di pipol make dem listin well-well! Nor keep di news as sekret! Tell dem sey, ‘Dem go seize Babilon kon disgrace Bel and skata Marduk wey bi dia gods, den distroy all dia juju.
Yor sore nor get cure and nobody go fit heal yu again. Doz wey hear as dem take distroy yu, dey klap and sing with joy, bikos yor wahala and trobol, too mush.
Anoda angel follow di first one kon sey: “E don fall! Babilon don fall! Babilon wey make all di kountries drink di wine wey make dem dey sleep with who dem nor marry.”
E shaut with loud vois sey: “E don fall! E don fall! Babilon wey big well-well don fall! E don bikom di place where demons, evil spirits, bird and animal wey pipol hate, dey stay.