Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 51:64 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

64 sey, ‘Dis na wetin go happen to Babilon. E go sink and e nor go raiz-up again, bikos of di way God go distroy am.’ ” Na here Jeremaya message for finish.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 51:64
16 Iomraidhean Croise  

den instead of fruit or korn to grow, make bush and grass grow full dat land!” Den Job kon stop to dey tok.


David wey bi Jesse pikin, na here en prayers for end.


E dey honbol prince and kings for dis eart, dey fear am.


Even all di many advise wey dem advise yu don make yu weak well-well. Yor pipol wey dey read di star and doz wey dey tok as weda go bi, make dem kom out kon save yu from wetin go soon happen to yu.


“Di short nika wey yu buy and wear so, pul and take am go Perat. Dig and hide am for one hole wey dey di rock near Eufrates River.”


God still sey, “Naw, make yu break di pot for di pipol front


Den God tell mi, “Tell di pipol sey mi, Israel God wey dey mighty, dey kommand dem make dem drink till di drink katch dem. Dem go dey vomit until dem fall for groun and dem nor go fit get up again, bikos I dey send war kom meet dem.


Di sea rush enter Babilon and naw e don kover di town.


Dem go distroy Babilon strong wall kon burn dia big-big gate. Evritin wey Babilon build, go skata go like dat.”


Friends dey deceive friends and nobody dey tok trut. Dem don train demsef to dey lie and do bad tins. Dem nor gri turn from sin kom meet God.


Naw, fear dey katch all di kountries wey bin dey kom meet yu, bikos yor end don rish.”


But make una dey sure about dis! Oga God wey dey kommand heaven sojas don tok: Evritin wey di nashons dey do nor mean anytin; all dia work go dey yuzles.


Anoda angel follow di first one kon sey: “E don fall! Babilon don fall! Babilon wey make all di kountries drink di wine wey make dem dey sleep with who dem nor marry.”


E shaut with loud vois sey: “E don fall! E don fall! Babilon wey big well-well don fall! E don bikom di place where demons, evil spirits, bird and animal wey pipol hate, dey stay.


Den one angel wey get pawa, pick one big stone, trow am inside sea kon sey: “Na so dem go take trowey Babilon di big town with force enter sea!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan