Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 51:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 So, make una run komot Babilon town! Make una run for una dear life! Make una nor die for nor-tin, bikos of Babilon pipol sin. I dey take my revensh and I go ponish dem well-well.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 51:6
29 Iomraidhean Croise  

My Oga wey dey fight for pipol. Di God wey dey take revensh, make Yu show us yor glory!


Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too; but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu.


So naw, make una komot from Babilon, make una run komot from der! Make una shaut with joy as una dey tok about am. Make una tell evribody for di world sey, ‘God don save Jakob en savant.’


I just feel sey di time to save my pipol don rish and na di rite time to ponish dia enemies bi dis.


I go pay Babilon pipol back for wetin dem do and dem go bi slave to many nashon and great kings.’ ”


Wen dem drink am finish, dem go stagga kon dey bihave anyhow, bikos I dey send war kom meet dem.”


All di nashons go serve en and en shidren-shidren, until wen en own nashon go fall. Den Babilon go bi savant to nashons wey get pawa and great kings.


Na God wey dey mighty get today. Today, E go take revensh kon ponish all en enemies. En swod go kill all of dem. God wey dey mighty don sakrifice doz wey fall for en trap for di nort side for Eufrates River.


Dem sey, ‘Make una kwik-kwik run for una life! Make una run like donkey for desert!’


Make una shaut for war for evriwhere for di town! Den, Babilon pipol go surenda. Dem go skata di town wall, bikos mi wey bi God, dey take revensh. So make una trit am, just as e trit odas.


(Make una listin! Pipol wey nor get house dey run komot from Babilon go Jerusalem kon tok as di Oga awa God ponish Babilon pipol, bikos of wetin dem do to en temple.)


God sey, “Babilon pipol, bikos una too karry body, mi wey bi God, dey against una! Time don rish wen I go ponish una.


So Judah pipol, make una kwik-kwik komot from Babilon! Make una bi di pipol wey go first komot from der. Make una bi like man goat wey dey lead di oda goats.


So God go use Media kings take distroy Babilon. E go revensh bikos of en temple wey Babilon sojas distroy. Media sojas oga kon kommand sey, ‘Make una sharp una arrow and karry una shield!


Dis na wetin God tell Jerusalem pipol: “I go bi una lawyer kon judge una kase, den I go fight for una. I go dry Babilon rivers.


So Israel pipol, make una run komot from der! Make una run for una dear life and from my vexnashon.


God tell en pipol wey dey Babilon, “Una don eskape deat! So make una dey go and nor wait! Even doh una dey far from una land, make una tink about mi wey bi una Oga God and una go remember Jerusalem.”


‘Wi don distroy Babilon. Wi don seize en sojas kon break dia bow.’ I bi di God wey dey ponish bad pipol and I go pay Babilon back.


Strenjas for der sey, ‘Wi bin won kom help Babilon town, but e don too late. Make wi leave am kon go back to awa house, bikos God don ponish Babilon pipol kon distroy di town.’ ”


So Oga God, make Yu pay dem back for all di bad tins wey dem don do.


E kon tell di kommunity sey, “Make una komot from doz wiked pipol tent and nor tosh anytin wey bi dia own, if not, God go distroy una bikos of dia sin.”


Di swod go bring deat for outside and for inside, fear go kill both men and wimen; small pikin and di ones wey don big.


I go make my lite sharp like swod and my hand go hold di judgement swod well-well; I go revensh doz wey make mi vex kon pay doz wey hate mi!


My pipol, make una happy, bikos God go fight for en savant; E go pay en enemies back kon sorry for en pipol and dia land.


Make yu nor hurry to make pesin leader and nor rush put hand for en head, so dat yu nor go karry anoda pesin sin for yor head. Make yu keep yorsef pure.


Den di big town divide into three and di nashons kon fall rish groun. So God remember Babilon wey big well-well and E gi-am di cup wey full with en vexnashon wine.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan