Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 51:47 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

47 So di time dey kom wen I go deal with Babilon juju. Di whole kountry go shame and dem go kill all en pipol.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 51:47
13 Iomraidhean Croise  

Si, men wey dey ride horse dey kom. Den di guide sey, “Babilon don fall! All di juju wey dem dey woship, skata for groun!”


So God wey dey mighty sey, “I go ponish dem! Dem go kill dia yong men for war and na honga go kill dia shidren.


Wetin una go tok wen di pipol wey una bin tink sey bi una friends katch, distroy and kon dey rule una? E go pain una like woman wey won born?


I go ponish anybody, profet or priest wey sey, ‘God message na wahala!’ I go ponish di pesin and all en family.”


“ ‘But wen di seventy years don finish, I go ponish Babilon and en king for dia sin. I go distroy and skata dat kountry forever.


“Make yu go tell di nashons di good news! Tell di pipol make dem listin well-well! Nor keep di news as sekret! Tell dem sey, ‘Dem go seize Babilon kon disgrace Bel and skata Marduk wey bi dia gods, den distroy all dia juju.


Dem dey yuzles and pipol dey use dem make yeye. Den wen di time rish, God go distroy all of dem.


But naw, una go si as I go take pay Babilon pipol for all di bad-bad tins wey dem do to Jerusalem.


Di town don turn where pipol dey fear to stay and e bi like desert wey nor get wota; where pipol nor dey stay or travel pass.


God sey, “Yes! Di time dey kom wen I go distroy all Babilon juju and for evriwhere for di land, dem go dey hear doz wey wound dey kry bikos of dia pain.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan