Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 51:37 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

37 Babilon go turn where dem dey trowey dirty put and trobol go dey follow am. Pipol go fear and hate dem and nobody go stay der again.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 51:37
24 Iomraidhean Croise  

Bikos of dis, God kon dey vex for Judah and Jerusalem pipol and wetin E do dem dey make evribody shake and fear.


I go turn Babilon to where birds and wild animals dey stay and wota wey nor dey go front or back, go full di land. I go swip am trowey, just as pesin dey use broom take swip dirty trowey.”


Naw, di land go turn to where pipol go dey fear and hate. All di pipol wey go pass am, go sopraiz and shake dia head, bikos of wetin dem si.


I go distroy dis place well-well. Pipol wey dey pass go shok and shake dia head, bikos of wetin happen.


“ ‘But wen di seventy years don finish, I go ponish Babilon and en king for dia sin. I go distroy and skata dat kountry forever.


I go make Jerusalem and all di towns for Judah, dia kings and all dia ofisas drink from am, so dat di land go turn to desert, where dem dey trow dirty put and wen pipol si am, dem go shok with fear. Den pipol go use dia name dey curse pipol, just as dem don already dey use am.


‘I go koll di pipol wey dey nort and my savant King Nebukadnezzar for Babilon and dem go kom fight against Judah pipol and di towns wey dey round Jerusalem. I go distroy and skata dis nashon and di ones wey dey round am, forever. I go make pipol si and dey fear dem.


I go use war, honga and diziz take porshu dem, sotey all di oda nashons for di world go shok, fear, laf and curse dem for anywhere wey I skata dem go,


God sey, “Di wahala wey dey kom meet Edom pipol go bad well-well and wen pipol si am, dem go shok and fear go katch dem.


Hazor go turn desert forever and na only jackals go dey stay der. Nobody go ever stay der again.” ’ Mi, wey bi God, don tok.”


Di eart dey fear and shake, bikos God dey do wetin E plan wen E sey E go turn Babilon to desert where pipol nor dey stay.


God sey, “I go pak dirty full Jerusalem and jackals go dey stay der, den I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.”


Una dey obey only King Omri wiked laws and una wiked like King Ahab! So, I go use una as ezample kon distroy una finish. Dem go ponish una and evribody wey si una, go laf well-well.”


I nor go trit una with respet, instead I go kover una with dirty kon turn una to wetin pipol go dey look kon dey laf.


Dis na di find town wey dem guide well-well before. Di town bin dey boast sey, “Na mi great pass! E nor get any town wey bi like mi!” But naw, si as e don turn where dem dey trowey dirty put and na wild animals dey stay der naw. Evribody wey dey pass der, dey laf and shake dia head bikos of am.


E shaut with loud vois sey: “E don fall! E don fall! Babilon wey big well-well don fall! E don bikom di place where demons, evil spirits, bird and animal wey pipol hate, dey stay.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan