Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 51:36 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

36 Dis na wetin God tell Jerusalem pipol: “I go bi una lawyer kon judge una kase, den I go fight for una. I go dry Babilon rivers.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 51:36
24 Iomraidhean Croise  

bikos E turn river to desert and spring wota to land wey dry well-well.


But I know sey God go help di pipol wey dem dey opress kon judge well for poor pipol.


bikos God go judge dia kase for dem kon ponish doz wey dey treaten dia life.


Na God dey defend dem and E go judge dia kase against yu.


River Nile go dry and all di oda river for Egypt go dry finish.


Israel God wey dey holy, wey save una sey, “Bikos of una, I send sojas go Babilon kon break di town gate and di pipol happiness kon turn kry.


Na mi kommand di sea make e dry and e dry own.


Wahala go kom di land and all di rivers go dry finish. But, wetin make all dis tins dey happen? Na bikos juju full di whole land and di pipol love dem well-well.


So God go use Media kings take distroy Babilon. E go revensh bikos of en temple wey Babilon sojas distroy. Media sojas oga kon kommand sey, ‘Make una sharp una arrow and karry una shield!


So, make una run komot Babilon town! Make una run for una dear life! Make una nor die for nor-tin, bikos of Babilon pipol sin. I dey take my revensh and I go ponish dem well-well.


My pipol Israel go revensh Edom and dem go let Edom pipol feel how my vexnashon strong rish. Den Edom pipol go know wetin e mean to take revensh.” God wey get pawa don tok.


Even doh Israel dey grow like betta grass, I go send hot desert breeze from east kom dry dia rivers and well. E go distroy evritin wey dem value.


Make una nor try to pay anybody for di bad tin wey dem do una, but make una leave am for God, bikos God word sey, “Na mi go revensh for una. I go pay dem back.”


I go revensh and pay dem back wen dem go fall, bikos di day wen wahala go kom meet dem, don near well-well and dia judgement don almost full!”


My pipol, make una happy, bikos God go fight for en savant; E go pay en enemies back kon sorry for en pipol and dia land.


Den di sixt angel pour wetin dey en basin put for River Eufrates. Di river dry and road kon dey for di kings wey dey kom from east.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan