Den Sarai kon tell Abram, “Na yu curse dis wahala for mi! I allow yu make yu sleep with my savant, but as e know sey e don get belle, e nor kom dey respet mi again. Make God judge between yu and mi!”
So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”
Tell di sojas make dem attack Babilon. Make evribody wey sabi shot bow, surround di town so dat nobody go eskape. Una must pay dem back kon trit dem, just as dem trit odas, bikos dem dey karry body for mi wey bi di Holy One for Israel.
My God, make yu si all di wiked tins wey dem dey do. Make Yu ponish dem, just as Yu ponish mi for all my sins. My pains many and e dey make mi sick well-well.”
Just as una distroy Lebanon, na so too dem go distroy una finish. Una kill all di animals wey dey der, but naw, animals go worry and kill una. Dis tin go happen, bikos of di pipol wey una kill and di wahala wey una kause for dis world.
Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!”
But if e nor dey good for una eye, make Abimelek burn Shekem and Bet-Millo men with fire. Den fire go kom out from Shekem and Bet-Millo kon burn and kill Abimelek too.”