Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 51:34 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

34 King Nebukadnezzar for Babilon don skata, chop and distroy my town like empty cup. E swallow am like wiked animal and na awa propaty full en belle. E still porshu us komot from awa own land.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 51:34
21 Iomraidhean Croise  

Wiked pipol go vomit di money wey dem tif. God go take am back with di ones wey dey dia belle.


Yu divide di sea with yor pawa kon kill di monsta wey dey der.


If dem sey, “Even doh di pipol dey alive and okay naw, dem go die wen wi don deal with dem finish!


Na owls and ravens go dey stay di land. God nor go let am bear fruit again, just as e dey bear before wen God kreate di world.


But naw, dem don tif all en pipol tins; lock dem undagroun kon hide dem for prison. Dem tif from dem kon karry all dia tins komot and nobody dey to save dem.


God sey, “Israel pipol bi like sheep wey run skata for evriwhere bikos lion dey porshu dem. Assyria king first attack and kill dem, before King Nebukadnezzar for Babilon kon break dia bones.


Evribody wey si dem, dey attack dem. Dia enemies sey, ‘Nobody go ponish us for wetin wi do dem, bikos dis pipol don sin against di Oga God wey go give dem rest and wey dia grand-grand papa trust.’


I go ponish Bel wey bi Babilon god and make am drop all di tins wey e tif and di nashons nor go woship am again. Naw, Babilon wall don fall.


Na Babilon kill many pipol for dis world. Yes! Babilon go fall, bikos na-im make many Israel pipol die. Mi, wey bi God, don tok.”


Jerusalem, where many pipol dey stay before, don empty naw. Di town wey great pass oda nashons before, don bi like woman wey en husband die leave. Na Jerusalem bi kween for di world before, but naw, na slave e bi.


All yor enemies dey laf and happy sey, “At last, wi don distroy am! Wi don dey wait for dis day since and naw, e don kom.”


So go tell dem wetin mi God wey get pawa dey tok. Wen di kountries wey dey near Israel katch and seize Israel mountin, evribody bigin laf dem.


Israel pipol bi like oda nashons naw and dem dey yuzles like pot wey break.


Make una listin, una wey dey opress and distroy poor pipol wey dey di town.


Judah and Israel pipol bi like tree wey en enemies break en branches, but Oga God go make dem grow again kon give dem glory and pawa.


“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan