Si! Dem bi like grass wey fire burn trowey! Dem nor even fit save demsef, from di fire wey too hot for dem. Wen di weda kold, dem nor get fire to take warm demsef or di one dem go sidan near.
Babilon sojas don stop to fight and dem dey for dia tent. Dem nor get hope again and dem don weak like woman. Dem don break di town gate for groun kon burn all di house with fire.
Den dem break one part for di town wall rish groun and all di sojas kon run. Since Babilon pipol surround di town, Zedekaya and en men kon wait make nite rish, before dem pass di gate between di two walls wey dey back of di king gardin kon run dey go Jordan River side.