26 Di stone wey skata for una town, una nor go fit use am take build house again. Una go bi like desert forever.
I go turn Babilon to where birds and wild animals dey stay and wota wey nor dey go front or back, go full di land. I go swip am trowey, just as pesin dey use broom take swip dirty trowey.”
“ ‘But wen di seventy years don finish, I go ponish Babilon and en king for dia sin. I go distroy and skata dat kountry forever.
Di eart dey fear and shake, bikos God dey do wetin E plan wen E sey E go turn Babilon to desert where pipol nor dey stay.
Babilon go turn where dem dey trowey dirty put and trobol go dey follow am. Pipol go fear and hate dem and nobody go stay der again.
Di town don turn where pipol dey fear to stay and e bi like desert wey nor get wota; where pipol nor dey stay or travel pass.