So, make all of una gada kon listin to mi! Wish one among una juju don tell una all dis tins before? Di sojas wey God choose go do wetin E plan against Babilon.
Make una shaut for war for evriwhere for di town! Den, Babilon pipol go surenda. Dem go skata di town wall, bikos mi wey bi God, dey take revensh. So make una trit am, just as e trit odas.
So God go use Media kings take distroy Babilon. E go revensh bikos of en temple wey Babilon sojas distroy. Media sojas oga kon kommand sey, ‘Make una sharp una arrow and karry una shield!
Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!”