23 I still use una take kill shepads and dia animals; kill pipol wey dey tif and dia horse; den skata rulers and ofisas.
Na so too, I use una take kill men and wimen; kut both old and yong pipol and kill boys and girls too.
But naw, una go si as I go take pay Babilon pipol for all di bad-bad tins wey dem do to Jerusalem.
I go make en ofisas, wise men, leaders and sojas drink anyhow. Dem go sleep and dem nor go wake-up again. Mi, wey bi God, don tok. I bi di Oga God wey dey mighty.