Den Moses and Israel pipol bigin sing dey praiz God sey, “Wi go sing to God, bikos E don give us viktory. E trow di shariot and doz wey dey ride dem inside di sea.
Di One wey lead strong sojas go distroy Babilon, dia shariot and dia sojas. Dem fall for groun and dem nor go raiz again; dem dey go up like smoke wey dey kom out from lantan!
Dem go distroy en horse and shariot. Sojas wey dem hire from oda land, go dey fear and dem go weak like woman. All dia betta-betta tins go skata and pipol go tif and karry di ones wey remain.
But Oga God wey dey lead Heaven Sojas sey, “Nineveh pipol, I bi una enemy! I go burn una shariot kon kill una yong men for war. Evritin wey una take from oda nashons, I go take dem from una hand and nobody go hear una messenjas vois again.”
kon ova-trow and take kingdoms pawa from dem. I go distroy shariot and di pipol wey dey drive dem; di horse go die and di pipol wey dey drive dem, go kill each oda.
Oga God sey, “For dat time, I go make all di horse dey fear and di pipol wey dey ride dem nor go know wetin dem dey do. I go guide Judah pipol kon blind dia enemies horse eye.
Make una kom chop kings, ofisas, sojas, dia horse, di drivers and human being flesh: weda dem dey free or dem bi slave, big or small pipol, make una kom chop beleful!”