Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 51:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin and E don choose Israel as en own pipol. Na God wey get pawa, bi en name.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 51:19
19 Iomraidhean Croise  

Awa God dey for heaven and E dey do wetin E like.


True-true, God don choose Jakob as en own and Israel pipol as en own pipol.


My God, na Yu dey make mi strong and prosper; Yu don give mi betta future.


Si as blessing full di nashon wey God bi dia God, bikos God don take dem as en own.


My body fit fail and my spirit fit weak, but na God dey make my heart strong; na-im bi my own forever.


Make Yu remember sey na wi bi di pipol wey Yu choose since Yu kreate di world; di tribe wey Yu take as yor own! Make Yu still remember Jerusalem where Yu dey stay.


Awa Savior – di Oga God wey dey lead heaven sojas, naim bi en name; di Holy One for Israel.


Una don forget God wey make una; di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon? Why una dey always fear pipol wey dey opress una; doz wey ready to distroy una? But naw, una nor go fear dem again.


Na God make di eart with en pawa; na-im wisdom and undastandin E take kreate di heavens and eart.


Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin and E don choose Israel as en own pipol. En name na God wey dey mighty.”


Na mi, God do dis tins! Na mi God, make di eart kon put am for where e dey so. Dem know mi as Oga God; naw I dey tell yu,


God sey, “Babilon pipol! Una tif from my pipol and e dey make una happy. Una dey enjoy like animal wey dey chop betta green grass. Una dey sing with joy like di nois wey horse dey make.


But di Pesin wey go save dem, dey strong. Dem dey koll am Oga God wey dey rule ova evritin. E go fight for dem kon bring peace and rest kom di eart, but na trobol, wahala and pain go follow Babilon pipol.”


Mi, God wey dey mighty, neva forget Israel and Judah pipol, even doh dem sin against mi wey bi di holy God for Israel.


I tell mysef sey, “Na only God I get, so I go trust only en.”


Na God get di pipol for Israel; na Jakob bi en special propaty.


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan