Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 51:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Wen E kommand, di wota on-top sky dey make nois like wen lion dey shaut. E make di kloud kom out from di rite place. E make lite kom out for rainin sizin kon send breeze kom from where E keep dem put.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 51:16
24 Iomraidhean Croise  

But God remember Noah and all di animals wey dey inside di boat. So E make one breeze blow for di eart, den di wota kon dey dry small-small.


God wey dey send rain kom wota di eart, fit still send am kom ponish or favor us.


Yu don ever go where I dey keep di snow and di ice-blok rain, put?


Yu strong rish mi? Abi yor vois loud rish my own?


Wen Yu kommand, wota dey vanish and wen Yu shaut, e dey bi like tonda and di wota dey kwik-kwik rush komot.


E dey make kloud raiz kom from where di eart for end. Na en dey bring tonda kom wons rain dey fall and bring breeze kom out from where dem dey.


But as E kommand, di kold breeze and ice-blok kon melt. E send en breeze and di ice-blok kon turn wota.


God vois from heaven bi like tonda and evribody dey hear as di Most High dey shaut.


Nashons don skata and dia kingdoms dey fall! God shaut like tonda and di eart kon bigin melt!


bikos na en bi di Pesin wey dey di sky from one generashon go rish anoda! Si! Na-im dey make dat loud tonda nois.


God release di east wind for heaven kon guide di sout wind with en pawa.


So Moses stresh di stik wey dey en hand face Egypt. At wons, Oga God make one strong breeze from east blow kom Egypt, both for day and nite. For morning, di breeze from east don karry lokust enter di land.


Den God send anoda strong breeze from di sea and e karry all di lokust enter di Red Sea. No lokust remain for Egypt again.


So Moses stresh en hand face di sea and God kon divide di sea with strong breeze for nite, den di wota turn to dry land.


Pipol wey dey outside di kourtyard dey hear di nois wey di creatures feada dey make and e bi like sey na Oga God dey tok.


God sey, “Israel pipol, una dey important to mi pass Ethiopia pipol? Just as I bring Filistia pipol kom out from Krete and Siria pipol kom from Kir, na so too, I bring una kom out from Egypt.


But God send strong breeze go kause wahala for di sea and bikos di breeze strong well-well, di ship won kon break to pieces.


Wen sun start to shine, God kon send one hot breeze kom from east. Di sun dey shine for Jonah head and e nearly faint. So as Jonah dey vex, bikos di plant wey kover en head don die, e kon sey, “E betta make I die, dan dis life wey I dey live so.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan