Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 50:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Bikos I dey bring many strong nashons from di nort and dem go attack and distroy Babilon. Wen dia strong sojas shot dia arrow, e go-go meet and kill who dem shot am to! Dem nor dey miss at-all.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 50:9
20 Iomraidhean Croise  

Jonatan arrow nor stop to flow with pipol blood; e even skata strong wariors flesh. Saul swod nor taya to distroy many pipol for groun.


All of dem sabi use swod well and dem train dem well to fight war. Each of dem swod dey near dia waist and dem dey guide against anybody wey won attack dem for nite.


I si one bad vishon sey, “Di pesin wey dey lie, go lie well-well and di one wey dey distroy, go distroy well-well. Elam sojas, make una attack! Media sojas, make una hide attack di towns! But God go end all dis wahala.”


I don choose one pesin from east, I go bring am kon attack una from di nort and e go mash una just as pesin wey dey mold tins, dey mash klay.


I go make una serve una enemies for strenj land, bikos my vexnashon bi like fire and e go burn forever.”


I go pay Babilon pipol back for wetin dem do and dem go bi slave to many nashon and great kings.’ ”


di kings for nort both far and near and all di kingdoms wey dey dis eart. Afta all of dem don drink from God vexnashon cup finish, Babilon king must drink from am too.


All di sojas, make una ready to attack Babilon. Make una shot una arrows against di town, bikos dem don sin against God.


God sey, “Make una go attack, kill and distroy Merataim and Pekod pipol! Make una do evritin wey I kommand una.


Make una from far kom attack Babilon! Skata where dem keep dia food put! Gada am like dirty kon distroy am finish! Make una kill evribody wey dey der!


Tell di sojas make dem attack Babilon. Make evribody wey sabi shot bow, surround di town so dat nobody go eskape. Una must pay dem back kon trit dem, just as dem trit odas, bikos dem dey karry body for mi wey bi di Holy One for Israel.


Na from nort one nashon go kom attack and distroy Babilon. Babilon go turn desert where nobody dey stay, bikos en pipol and animals go run komot der.’ ”


So God go use Media kings take distroy Babilon. E go revensh bikos of en temple wey Babilon sojas distroy. Media sojas oga kon kommand sey, ‘Make una sharp una arrow and karry una shield!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan