Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 50:43 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

43 Babilon king go fear well-well wen e hear wetin en enemies tok. Wen e hear sey dem dey kom, fear and pain go nearly kill-am like woman wey won born.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 50:43
8 Iomraidhean Croise  

Naw, make una tink am well! Man fit get belle kon born pikin? So wetin make una men dey put dia hand for belle like sey dem bi woman wey won born? Wetin make evribody dey fear?


Enemies go attack Bozrah land like eagle wey spread en feada. For dat day, Edom sojas go dey fear and shake like woman wey won born.”


Damaskus pipol don weak and dem kon run, bikos dem dey fear. Dem dey feel pain like woman wey won born.


Difren messenjas go run go tell Babilon king sey dem don break en town enter from difren korna.


I kry kon sey, “Wi don hear di news and fear dey katch us. So naw, wi dey pass thru pain like woman wey won born.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan