Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 50:40 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

40 Just as e bi wen I distroy Sodom and Gomorrah with di oda towns, na so too e go bi for Babilon. Nobody go ever stay der again. Mi, wey bi God, don tok.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 50:40
15 Iomraidhean Croise  

If to sey Oga God wey get pawa nor let some of di pipol survive, dem for don distroy Jerusalem finish, like Sodom and Gomorrah.


Na di same tin wey happen to Sodom and Gomorrah, go happen to Edom pipol; God go distroy dem and di village wey dey round dem. Nobody go ever stay der again. Mi, wey bi God, don tok.”


Di stone wey skata for una town, una nor go fit use am take build house again. Una go bi like desert forever.


“I distroy some of una town, just as I distroy Sodom and Gomorrah. And una wey remain bi like stik wey dey burn before dem komot am from fire. With all dis one, una still nor gri turn kom meet mi.” Na so Oga God tok.


Naw, God wey dey lead Heaven Sojas sey, “As long as I dey alive, I go distroy Moab and Ammon pipol finish, just as I distroy Sodom and Gomorrah. Na shuku-shuku go full dia land; I go turn am to salt pit and skata am forever. My pipol wey remain, go take evritin wey remain for di land.”


Just as Profet Isaya tok before sey: “If to sey God Almighty nor save some among awa shidren, wi for don die finish like Sodom and Gomorrah.”


Fire and sulfur go kover di whole land. Dem nor go fit plant for der and nor-tin go grow for der. E go bi like Sodom and Gomorrah, Admah and Zeboiim, di towns wey God vex distroy.


E still turn Sodom and Gomorrah to ashes wen E distroy dem, den E use dem as ezample for di pipol wey dey live bad life,


Make una use Sodom and Gomorrah and di towns wey dey near dem, as ezample. God ponish dem with fire wey nor dey end, bikos both men and wimen dey sleep with each oda anyhow, dem even dey sleep with animals and dem dey do oda wiked tins wey dey dia mind.


Dia dead body go dey for di main street for Jerusalem wey pipol dey koll “Sodom and Egypt” and dis na di town where dem for nail Christ for cross.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan