Jeremaya 50:38 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
38 Wahala go kom di land and all di rivers go dry finish. But, wetin make all dis tins dey happen? Na bikos juju full di whole land and di pipol love dem well-well.
“Make yu go tell di nashons di good news! Tell di pipol make dem listin well-well! Nor keep di news as sekret! Tell dem sey, ‘Dem go seize Babilon kon disgrace Bel and skata Marduk wey bi dia gods, den distroy all dia juju.
God sey, “Yes! Di time dey kom wen I go distroy all Babilon juju and for evriwhere for di land, dem go dey hear doz wey wound dey kry bikos of dia pain.
Babilon pipol bi like gold cup for my hand a nd di wine for inside dey shark di whole world. Di nashons drink from am and dem kon start to bihave anyhow.