Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 50:37 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

37 Dem go distroy en horse and shariot. Sojas wey dem hire from oda land, go dey fear and dem go weak like woman. All dia betta-betta tins go skata and pipol go tif and karry di ones wey remain.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 50:37
20 Iomraidhean Croise  

E stop all di war for di eart kon break di bow and skata di spear, den E burn di shield with fire.


My Oga wey bi Jakob God, wen Yu breath, all yor enemies horse and shariot dey fall die.


For dat time, Egypt pipol go bi like wimen. Dem go shake dey fear bikos Oga God wey dey lead heaven sojas don dey ready to ponish dem.


I go give yu betta tins wey dem hide for dark and sekret place. Den yu go know sey, na mi bi God! Israel pipol God, wey koll yor name.


di strenjas for Egypt; di kings for Uz land; di kings for Filistia land, Ashkelon, Gaza, Ekron pipol and di pipol wey dem nor kill for Ashdod town;


di kings for Arabia wey dey stay desert;


and dem go seize di town and all en strong building. For dat day, Moab sojas go dey fear like woman wey won born.


Dem go tif and karry evritin wey dey Babilon. Mi, wey bi God, don tok.”


Make una from far kom attack Babilon! Skata where dem keep dia food put! Gada am like dirty kon distroy am finish! Make una kill evribody wey dey der!


I still use una take skata horse, shariot and di pipol wey dey ride dem.


Na so too, I use una take kill men and wimen; kut both old and yong pipol and kill boys and girls too.


Babilon sojas don stop to fight and dem dey for dia tent. Dem nor get hope again and dem don weak like woman. Dem don break di town gate for groun kon burn all di house with fire.


Dem go wound kon fall die for all di street wey dey dia towns.


“All di sojas wey dem hire kom from Sudan, Libya, Lydia, Arabia, Put and even from among my own pipol, go die for dat war.”


For my tabol, dem go chop all wetin dem fit chop from shariot and from all di sojas body. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”


But Oga God wey dey lead Heaven Sojas sey, “Nineveh pipol, I bi una enemy! I go burn una shariot kon kill una yong men for war. Evritin wey una take from oda nashons, I go take dem from una hand and nobody go hear una messenjas vois again.”


Una sojas weak like woman wey nor get who to help am. Dem go open una town gate for una enemies and dem go put fire kon burn am rish groun.


kon ova-trow and take kingdoms pawa from dem. I go distroy shariot and di pipol wey dey drive dem; di horse go die and di pipol wey dey drive dem, go kill each oda.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan