Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 50:33 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

33 God wey dey mighty sey, “Dem dey opress Israel and Judah pipol. Doz wey katch dem don turn dem to prisonas. Dem nor gri let dem go.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 50:33
16 Iomraidhean Croise  

But Fero ask dem, “Who bi dis God wey go make mi fear am kon let Israel pipol go? I nor know am, so I nor go let Israel pipol go.”


But if yu nor gri release dem, den I go make frog kover una land and una go sofa.


Nor bi dis man distroy towns kon turn di world to desert? Yes! Na di man nor gri free en prisonas make dem go dia house!”


I bin dey vex for my pipol and na dat make mi allow yu attack dem; but yu nor sorry for dem at-all and yu even dey ponish di old pipol among dem.


But I go gi-am to pipol wey dey opress una; doz wey dey make una liedan for street kon waka on-top una like sey una bi dirty.”


Nor bi dis kind fasting I choose; but wetin I wont bi sey: ‘Make una remove sin from una body kon give betta judgement, den free pipol wey una dey opress.


Dia shidren-shidren go bi as dem bi before and dem go always dey my present, den I go ponish di pipol wey bin dey opress dem.


Evribody wey si dem, dey attack dem. Dia enemies sey, ‘Nobody go ponish us for wetin wi do dem, bikos dis pipol don sin against di Oga God wey go give dem rest and wey dia grand-grand papa trust.’


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan