Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 50:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 Make una kill all dia sojas anyhow! Babilon pipol own don finish, bikos di time don rish wen I must ponish dem.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 50:27
22 Iomraidhean Croise  

From east go west, evribody wey hear wetin happen to dem, go fear kon sey,


My enemies gada round mi like strong melu and wiked animals from Bashan. Dem gada won bite mi!


But God just dey laf, bikos E know sey di day to judge dem, don near well-well.


So I ansa, “Morning dey kom, but nite go kom again. So if yu won ask again, wen dat time rish, make yu kom back kon ask.”


Na dia blood and flesh full God swod like sey na lamb, goat or animal wey dem take do sakrifice. God go do dis sakrifice for Bozrah town and E go kill Edom pipol well-well for di land.


God go kill dem with all dia animals. Blood go kover dia land and di pipol flesh go kover evriwhere.


But my God, Yu know mi! Yu dey si evritin wey I dey do and how I love Yu rish. Make Yu take dis wiked pipol komot like sheep wey dem won go kill. Tell us wen dem go die.


Una wey bi leaders and my pipol shepad, make una shaut kry well-well! Make una mourn and roll for san-san, bikos di time don rish wen dem go kill una kon kut una like goat


All di nashons go serve en and en shidren-shidren, until wen en own nashon go fall. Den Babilon go bi savant to nashons wey get pawa and great kings.


Even di sojas wey dem hire lazy like small goat. Instead make dem stand fight, na run dem dey run. Di day for dem to face wahala and ponishment, don kom.


(Pesin wey nor do God work with all en heart, na curse go follow am and na di same curse go follow who nor bring en swod kom out to take kill!)


Dem don distroy Moab town and all en pipol; all di fine yong men for der, dem don kill dem finish. Na mi bi di king, di God wey dey mighty, and I don tok.


God still sey, “Anybody wey try eskape di wahala go fall enter di pit and anybody wey fit kom out from di pit go enter trap, bikos God don set di time wey dem go distroy and skata Moab.


God sey, “Babilon pipol! Una tif from my pipol and e dey make una happy. Una dey enjoy like animal wey dey chop betta green grass. Una dey sing with joy like di nois wey horse dey make.


God sey, “Babilon pipol, bikos una too karry body, mi wey bi God, dey against una! Time don rish wen I go ponish una.


I go karry dem go kill like lamb, goats and rams.”


Even doh dem hear sey I dey sofa, nobody gri kom konfort mi. My enemies know sey I dey trobol and dem dey happy to si as God ponish mi. Make di Judgement Day wey Yu promise kom, so dat dem go sofa, just as I don sofa so.


Bikos di kings nor one join am sofa, dem go stand far dey sey, “E bad well-well! Babilon, di big town wey get pawa! E bad well-well for yu! Na for only one hour God take distroy yu finish!”


Den I si one angel stand for di sun and e shaut give all di bird for sky sey: “Make una kom, make una gada round kom chop for God party.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan