So Moses and Aaron go meet Fero kon tell am, “God wey bi Hibru pipol God sey: ‘Na how long e go take yu before yu go honbol yorsef for where I dey? Make yu let my pipol go woship mi!
True-true, nobody know di time wen dis tins go happen! Like fish wey net katch or bird wey enter trap, na so too, wahala just dey kom meet pipol by sopraiz.
God sey, “I go bring wahala kom di eart and I go ponish all di wiked pipol, bikos of dia sin. I go make anybody wey dey proud, honbol and I go ponish evribody wey dey sturbon and wiked.
E nor go betta for di pesin wey dey argue with di Pesin wey kreate am! Pesin wey bi like ordinary pot for where oda pots dey for groun. Klay fit tell who dey use am sey, “Wetin yu dey do?” Abi di pot wey yu dey make fit sey, “Yu nor know work at-all?”
God still sey, “Anybody wey try eskape di wahala go fall enter di pit and anybody wey fit kom out from di pit go enter trap, bikos God don set di time wey dem go distroy and skata Moab.
I go make en ofisas, wise men, leaders and sojas drink anyhow. Dem go sleep and dem nor go wake-up again. Mi, wey bi God, don tok. I bi di Oga God wey dey mighty.