Terah kon karry en pikin Abram, en grand-pikin Lot and en pikin wife Sarai, dey follow body go Ur for Kaldea, so dat dem go-go Kanaan. Wen dem rish Haran, dem kon stay for der.
As dis one still dey tok, anoda savant run kom sey, “Oga! Kaldea pipol form three group kom attack us. Dem karry all di kamel kon kill yor savant dem and na only mi one eskape kom tell yu.”
Make una si Kaldean town, pipol wey nor know where dem from kom! Assyria pipol don turn di land to where wild animals dey stay. Dem don skata dia towas, distroy dia strong town kon turn am to where dem dey trow dirty put.
Anoda angel follow di first one kon sey: “E don fall! Babilon don fall! Babilon wey make all di kountries drink di wine wey make dem dey sleep with who dem nor marry.”