Na so-so wiked tins pipol wey dey deceive odas dey tink and na di wiked tins wey dem won do to poor pipol, dem dey always dream about, even wen di poor pipol dey do wetin dey rite.
Na evil dem dey take pay good? Naw, dem don dig pit for mi make I fall inside. Wen Yu dey vex dat time, make Yu remember as I beg Yu bikos of dem, so dat Yu nor go ponish dem.
But God sey, “My pipol foolish well-well, dem nor know mi at-all. Dem bi shidren wey nor get sense and dem nor dey kwik undastand anytin. Na only bad-bad tins dem sabi do.”
Betta pipol wey dey fear God, don die komot di eart and e nor get anybody wey dey good and honest for dis eart again. Evribody for di eart dey wait to kill each oda; dem dey set trap dey wait dia brodas for road.
James and John wey bi Zebedee shidren, wey dey follow Pita work, sopraiz too. Den Jesus tell Simon Pita, “Make yu nor worry, from today go, na pipol yu go dey katch.”