I go save and dey with una. I go distroy all di nashons where I skata una go, but I nor go distroy una finish. I go ponish una, but I go do am small-small. Yes! I nor go let una go without ponishment. Mi, wey bi God, don tok.”
So God kommand di enemies sey, “Make una go distroy di vines for Israel and di vineyard for Judah, but nor distroy dem finish. Kut dia branches komot, bikos doz branches nor bi God own.
Dem go chop evritin wey una plant and una animals too; dem nor go leave one fruit for una vine tree. Even doh una tink sey una dey save inside una strong town, dem go distroy di town kon kill una shidren.
So Jeremaya, anytime wey yor pipol ask, “Wetin make di Oga God ponish us like dis? Make yu ansa, ‘Na bikos dem leave God go woship oda gods for dia land and bikos of dat, una must go serve as slave for anoda land.’ ”
As I still dey tok, Pelataya wey bi Benaya pikin, kon fall die. I fall face groun kon shaut, “God wey get pawa well-well, nor bi so o-o! Yu won kill evribody wey remain for Israel?”
Na only mi dey der wen dem start to kill. So I fall face groun kon shaut, “Oga God wey get pawa well-well, na so Yu dey vex for Jerusalem? Yu wont kill evribody wey dey Israel?”
My Oga God, di Pesin wey dey holy, Yu wey dey since and go always dey. Oga God wey bi awa Rock, Yu nor dey plan to kill us finish, Yu only send Babilon pipol to kom korrect and ponish us bikos of awa sin.