Just as no one among di juju for dis nashon fit bring rain, na so too di sky nor fit make rain fall by ensef. So wi don put awa hope for yor hand. Na Yu bi awa God, bikos na only Yu fit do all dis tins.”
Dem nor even ask sey, ‘Where God wey take us komot from Egypt? Di Pesin wey take us pass wildaness and desert, land wey nor good and dey dry, where pipol nor dey stay or travel pass.’
Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin and all Judah pipol wey go Babilon as slave, I go bring dem kom back. Yes! I go break Babilon king pawa. Mi, wey bi God, don tok.’ ”
Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?
Dia vishon na lie and anytin wey dem tok sey go happen, nor dey happen. Dem dey sey na my message dem dey prish, but I nor send dem and dem dey espect sey wetin dem tok, go happen!
Una leaders nor dey judge well, bikos dem don take bribe and una priest dem dey do dia work, bikos of money. Una profets nor dey profesai unless dem first pay dem. Yet all of una sey una trust God. Una sey, “Nor-tin go happen to us, bikos God dey with us.”
“Make una make sure sey nobody among una wey dey hear dis tins today, bilive sey evritin dey okay with am, even doh e nor dey hear pipol word. Dis kind tin go skata all of una, weda una dey good or bad.
(Di pesin wey bilive God Pikin, go know inside ensef sey, dis tin na true, but pesin wey nor bilive God, dey sey God dey lie, bikos e nor bilive wetin God tok about en Pikin).
But make una dey look am. If only di truck go by ensef to Bet-Shemesh borda, den make una know sey na God give una dis big wahala. But if e nor go like dat, den wi go know sey nor bi en dey give us dis wahala; instead, e just happen to us like dat.”