Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 49:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 So, I go take dia kamel and all dia animals! I go skata pipol wey kut dia hair kon bring wahala kom meet dem from evry side.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 49:32
8 Iomraidhean Croise  

Dedan, Tema, Buz and all di pipol for desert wey kut dia hair short as dem dey di temple;


I go make breeze blow against Elam from difren direcshon kon skata en pipol go evriwhere, until en pipol don run go hide for all di kountry wey dey dis world.


God sey, “Doz wey dem sekonsaiz, but nor dey keep di kovenant wey make dem sekonsaiz dem, time dey kom wen I go ponish dem.


I go ponish Egypt, Judah, Edom, Ammon, Moab and di pipol for desert wey kut dia hair short for di temple. Even for Israel, nobody wey dem sekonsaiz, keep my kovenant for en heart.”


Bikos of dis, for Jerusalem, papa and mama go chop dia pikin and shidren go chop dia papa and mama. I go ponish una and doz wey go remain wey nor die, I go skata dem for evriwhere for dis world.


Some of una go die bikos of honga; sickness go kill some; swod go kill anoda set for outside di town and di remain wons, I go skata dem for air kon porshu dem with my swod.


bikos God go skata una among many kountries from one end for di eart go rish di oda end. For der, una go woship gods wey una or una grand-grand papa nor know before; gods wey dem make with wood and stones!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan