Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 49:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 “Kom, make wi go attack doz pipol wey dey save and sikure! Dia town nor get gate or wetin dem take dey lock am, so dem nor dey protet am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 49:31
17 Iomraidhean Croise  

Di wahala wey wi get, don taya us and awa trobol, plenty well-well.


Si dis wiked pipol dey enjoy life, bikos dia money dey plenty.


Una dey enjoy life since and nor kare about anytin, but naw, make una shake dey fear! Make una pul una klot kon tie rag for una waist.


Wimen wey dey enjoy life, make una listin to wetin I dey tok! Di wimen wey get heart well-well and nor kare about anytin, make una listin to mi:


Make all di desert and en towns praiz God; Make Kedar pipol praiz am! Make doz wey dey stay for Sela town shaut dey happy on-top di mountins!


Naw, make yu listin, yu wey dey enjoy yorsef kon tink sey yu dey save and sikure. Yu tell yorsef sey, ‘I too mush and nobody bi like mi. My husband or shidren nor go ever die.’


God sey, “Moab pipol dey always stay for peace and dem neva ever karry dem go do slave work. Moab pipol bi like wine wey dem leave make e setol rish groun; wine wey dem nor dey pour from cup to cup. Yes! Di wine still sweet and en taste still good as e bi before.


“For dat same day afta I don distroy Egypt finish, I go send messenjas for ship go tell Ethiopia pipol sey wahala dey kom. Dem dey tink sey dem dey save, but naw, fear go katch dem.”


Yu go skata Israel kountry wey nor get who dey protet dem; place where di pipol nor get pawa and dey stay for peace.


“I go set fire put for Magog land and land near di river where pipol dey stay for peace. Den evribody go know sey na mi bi God.


Naw, my God, make Yu protet yor pipol with yor shepad stik. Make Yu lead yor pipol wey dey special for yor eye. Even doh dem dey stay alone for bush, make yu let dem chop betta food wey dey Bashan and Gilead, just as dem dey do before.


So Israel pipol, dis na wetin God tok: “Even doh Assyria sojas get pawa and dem many well-well, I go distroy and skata dem finish for dis world. My pipol! I know sey I don ponish una before, but I nor go ponish una again.


Dis na di find town wey dem guide well-well before. Di town bin dey boast sey, “Na mi great pass! E nor get any town wey bi like mi!” But naw, si as e don turn where dem dey trowey dirty put and na wild animals dey stay der naw. Evribody wey dey pass der, dey laf and shake dia head bikos of am.


I dey si dem from where I stand on-top di rock; I dey look dem from di hill. Dem bi one nashon wey dey stay alone; dem know sey dem dey bless pass oda nashon.


So Israel pipol go stay for peace, Jakob pipol go prosper for di land wey get food and wine and dew go drop from heaven.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan