Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 49:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Enemies go attack Bozrah land like eagle wey spread en feada. For dat day, Edom sojas go dey fear and shake like woman wey won born.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 49:22
21 Iomraidhean Croise  

na so-so grave I dey dream about and na to die, dey hongry mi.


“ ‘How eagle take dey fly high-high for sky? How snake take dey waka for rock? How ship take dey move for river and how man take dey love woman?’


Dem go attack Filistia pipol togeda for di west kon kill di pipol wey dey east. Dem go distroy Edom and Moab pipol and Ammon pipol go dey obey dem.


Fear go katch all of dem with pain like woman wey won born. Dem go dey look each oda with fear and shame go full dia face.


So bikos of all dis tins wey I hear, my belle kon dey pain mi and e dey make mi fear. E dey pain mi like woman wey won born.


Just as woman wey get belle dey kry and shaut with pain wen e won born, na so too wi dey kry from awa heart for Yu wey bi awa Oga God.


Wetin una go tok wen di pipol wey una bin tink sey bi una friends katch, distroy and kon dey rule una? E go pain una like woman wey won born?


Una fit tink sey una dey save like bird wey dey rest for Lebanon cedar. But wen di wahala kom, una go kry with pain like woman wey won born.


Naw, make una tink am well! Man fit get belle kon born pikin? So wetin make una men dey put dia hand for belle like sey dem bi woman wey won born? Wetin make evribody dey fear?


Yes, di enemies go kom like kloud. Dia shariot bi like strong breeze and dia horse fast pass eagle.” Den I kon kry, “Wi don die finish o-o, bikos dem go distroy us!”


I hear kry, like woman wey won born; shaut like woman wey dey born en first pikin. Jerusalem pipol dey find as dem go take breath and naw, dem dey kry sey, “Make una help us! Bikos na die wi dey so o-o!”


Damaskus pipol don weak and dem kon run, bikos dem dey fear. Dem dey feel pain like woman wey won born.


Dem go distroy en profets wey dey lie and pipol go si dem as fools! En sojas go dey die and fear go turn dem to mumu.


Babilon king go fear well-well wen e hear wetin en enemies tok. Wen e hear sey dem dey kom, fear and pain go nearly kill-am like woman wey won born.


I kry kon sey, “Wi don hear di news and fear dey katch us. So naw, wi dey pass thru pain like woman wey won born.


“Di first one bi like lion wey get eagle feada. As I dey look am, dem remove di feadas kon karry am komot groun. Dem make am stand with two leg like human being kon gi-am human being mind.


“Blow di trumpet! Enemies dey rush dey kom attack my pipol like eagle! My pipol don break di kovenant wey I make with dem kon go against my laws.


“Doz strong sojas from Teman go fear and dem go kill evribody wey dey Edom mountin.”


God go bring some pipol from far against una and dem go kill una like vulture. And dem bi pipol wey una nor go undastand wetin dem dey tok;


Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan