Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 49:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Na di same tin wey happen to Sodom and Gomorrah, go happen to Edom pipol; God go distroy dem and di village wey dey round dem. Nobody go ever stay der again. Mi, wey bi God, don tok.”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 49:18
16 Iomraidhean Croise  

E go burn wiked pipol with shako, sulfur and fire kon distroy dem with strong breeze.


E go dey burn both for day and nite and smoke go dey kom out from am forever. Nobody go ever fit stay or travel pass di land from one generashon go rish anoda.


But I si sey na Jerusalem profets own worse pass; dem dey sleep with who dem nor marry; dey lie; dey enkourage pipol to do bad tins, so dat dem nor go stop to live dia wiked life. To mi, all of dem bad and wiked like Sodom and Gomorrah pipol.


Hazor go turn desert forever and na only jackals go dey stay der. Nobody go ever stay der again.” ’ Mi, wey bi God, don tok.”


Just as e bi wen I distroy Sodom and Gomorrah with di oda towns, na so too e go bi for Babilon. Nobody go ever stay der again. Mi, wey bi God, don tok.


“I distroy some of una town, just as I distroy Sodom and Gomorrah. And una wey remain bi like stik wey dey burn before dem komot am from fire. With all dis one, una still nor gri turn kom meet mi.” Na so Oga God tok.


Naw, God wey dey lead Heaven Sojas sey, “As long as I dey alive, I go distroy Moab and Ammon pipol finish, just as I distroy Sodom and Gomorrah. Na shuku-shuku go full dia land; I go turn am to salt pit and skata am forever. My pipol wey remain, go take evritin wey remain for di land.”


Just as Profet Isaya tok before sey: “If to sey God Almighty nor save some among awa shidren, wi for don die finish like Sodom and Gomorrah.”


“En shidren-shidren wey go kom afta una, plus di strenjas wey go kom from far place, all of dem go si di wahala for dat land and di sickness wey God go send for dia head.


Fire and sulfur go kover di whole land. Dem nor go fit plant for der and nor-tin go grow for der. E go bi like Sodom and Gomorrah, Admah and Zeboiim, di towns wey God vex distroy.


E still turn Sodom and Gomorrah to ashes wen E distroy dem, den E use dem as ezample for di pipol wey dey live bad life,


Make una use Sodom and Gomorrah and di towns wey dey near dem, as ezample. God ponish dem with fire wey nor dey end, bikos both men and wimen dey sleep with each oda anyhow, dem even dey sleep with animals and dem dey do oda wiked tins wey dey dia mind.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan