Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 49:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 God still sey, “Even doz wey I nor suppose ponish, go drink from di ponishment cup. Abi una bin tink sey I nor go ponish una? No! Una must drink from dat cup!

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 49:12
9 Iomraidhean Croise  

If yu dey laf poor pipol, den yu dey curse God wey kreate dem, so pesin wey dey happy sey odas fall, God go ponish am.


Oga wey bi Israel God tell mi, “Make yu take dis wine cup wey my vexnashon full and make all di nashons wey I send yu go meet, drink from am.


I go save and dey with una. I go distroy all di nashons where I skata una go, but I nor go distroy una finish. I go ponish una, but I go do am small-small. Yes! I nor go let una go without ponishment. Mi, wey bi God, don tok.”


“So make my pipol, Israel nor fear! Make una heart nor shake. I go save una from dat land wey far wey una for bi prisonas. Una go kom back to una land kon stay for peace. Una go dey save and nobody go make una fear again.


Just as una swallow my pipol for my holy mountin, na so too una and di oda nashons go swallow di ponishment wey I go give una. Una go drink kon stagga until una disappear komot from dis eart.


Jesus ask dem again, “Una know wetin una dey ask for so? Una go fit drink from di cup wey I won drink from?” Dem ansa, “Yes! Wi go fit.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan