Bikos God nor fit bear all di yeye tins wey una dey do, na dis make am turn una land to where pipol dey curse. E don skata am and pipol nor dey stay der again.
Naw, God wey dey lead Heaven Sojas sey, “As long as I dey alive, I go distroy Moab and Ammon pipol finish, just as I distroy Sodom and Gomorrah. Na shuku-shuku go full dia land; I go turn am to salt pit and skata am forever. My pipol wey remain, go take evritin wey remain for di land.”
But dem give di woman two feada like eagle own, so dat e go fly go di place where dem prepare for am for wildaness. For der, dem go kare for am kon protet am from di dragon for three and half years.