Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 48:46 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

46 Curse dey Moab land! Di pipol wey dey woship Kemosh don skata and di enemies don karry dia shidren go as prisonas.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 48:46
7 Iomraidhean Croise  

For di east side for Jerusalem hill, e build where dem for dey woship Kemosh, wey bi Moab pipol yeye god and Milkom, wey bi Ammon pipol god.


Di king skata all di high place for Jerusalem east and Distroshon Mountin for sout, wey King Solomon build for Sidon pipol juju, Astarte and Kemosh di ashawo juju for Moab pipol, plus Ammon pipol juju wey bi Milkom.


Moab wimen dey wait for Arnon River front; dem dey waka up-and-down like birds wey dem drive komot from en house.


Den, just as Israel pipol shame for dia god for Bethel, na so too Moab pipol go shame for Kemosh wey bi dia god.


Moab! Yu trust yor pawa and di many money wey yu get, but naw, yu go die and strenjas go karry Kemosh wey bi yor god, en prince and priests, go anoda land.


Moab pipol, curse dey una head. Kemosh pipol, una don skata! Una make una sons dey run anyhow and una dotas don turn King Sihon for Amor, prisonas.


Yu fit take anytin wey Kemosh yor god give yu, but wi go take all di land wey di Oga awa God give us.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan