Naw, make una tink am well! Man fit get belle kon born pikin? So wetin make una men dey put dia hand for belle like sey dem bi woman wey won born? Wetin make evribody dey fear?
I hear kry, like woman wey won born; shaut like woman wey dey born en first pikin. Jerusalem pipol dey find as dem go take breath and naw, dem dey kry sey, “Make una help us! Bikos na die wi dey so o-o!”
Dem go distroy en horse and shariot. Sojas wey dem hire from oda land, go dey fear and dem go weak like woman. All dia betta-betta tins go skata and pipol go tif and karry di ones wey remain.
Babilon sojas don stop to fight and dem dey for dia tent. Dem nor get hope again and dem don weak like woman. Dem don break di town gate for groun kon burn all di house with fire.
So I go use fire take distroy Moab town kon burn Keriot strong-strong buildings rish groun. Moab pipol go die for war and dia sojas go dey shaut and trumpet dey blow.
Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.