Den Dibon pipol go klimb di hill go kry for dia shrine bikos of wetin happen to Nebo and Medeba town. Moab pipol go kry well-well. Evribody go barber bololo kon shave dia bear-bear.
Judah pipol gods plenty, just as di towns wey dem get. And as Jerusalem street plenty rish, na so too di altar wey dem build for Baal juju, plenty too.
Moab! Yu trust yor pawa and di many money wey yu get, but naw, yu go die and strenjas go karry Kemosh wey bi yor god, en prince and priests, go anoda land.
Una go still give di wine ofrin with each sakrifice: two kwota of wine for each melu, three kwota for di ram and one kwota for each lamb. Make una dey do dis sakrifice for di first day for evry mont