25 Dem don break and distroy Moab pipol pawa. Mi, wey bi God, don tok.”
Nor bi only sey yu nor gri help wimen wey nor get husband again, but yu dey ponish and kollect from shidren wey dia papa and mama don die.
Make Yu break wiked and evil pipol hand! Make Yu ponish dem for dia wiked plans wey dem tink sey Yu nor know about.
God go take wiked pipol pawa, but E go protet doz wey dey fear am.
God sey, “I go distroy wiked pipol with dia pawa kon give viktory to pipol wey dey fear mi.”
E vex distroy Israel pipol pawa; E nor gri help Israel wen dia enemies kom attack dem. Just as fire dey distroy tins, na so too E distroy Israel land.
“As I still dey look di horn, I si anoda small horn dey kom out from di big wons and three of di former horn kom skata make dis ones for fit kom out. Dis horn get eye wey bi like human being own and mout wey e take dey tok anyhow.
Di man goat na Greece king and di big horn wey dey between en eyes, na di first king.
Den I look again kon si one man whole ruler wey dem take dey measure.
Reuben pipol kon ribuild Heshbon, Elealeh, Kiriataim,