“Who bi dis pesin wey dey kom from Bozrah wey dey Edom? Who wear fine red klot dey waka kom with pawa and strent?” Na mi God wey dey speak with raitiousness, wey dey mighty and get pawa to save.
I don swear sey Bozrah town go turn desert wey go dey make pipol fear; pipol go laf and use dem as curse. I go skata all di village wey dey around dem forever. Mi, wey bi God, don tok.”
So I go use fire take distroy Moab town kon burn Keriot strong-strong buildings rish groun. Moab pipol go die for war and dia sojas go dey shaut and trumpet dey blow.
Dis towns na: Beza wey dey di wildaness high land for Reuben tribe; Ramot for Gilead wey bi Gad tribe own and Golan for Bashan wey bi Manasseh tribe own.