Doz wey dey distroy go distroy evry town. E nor get any town wey go eskape. Dem go distroy di town dem wey dey di valley with doz ones wey dey di hill too. Mi, wey bi God, don tok.
Naw, God wey dey lead Heaven Sojas sey, “As long as I dey alive, I go distroy Moab and Ammon pipol finish, just as I distroy Sodom and Gomorrah. Na shuku-shuku go full dia land; I go turn am to salt pit and skata am forever. My pipol wey remain, go take evritin wey remain for di land.”
But King Sihon nor gri make Israel pipol pass en aria; instead e gada all en sojas kon go attack Israel pipol for di wildaness. Wen e rish Jahaz, e kon fight against Israel pipol.