Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 48:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Moab men, why una dey bihave like sey una get pawa or sey una strong well-well for war?

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 48:14
12 Iomraidhean Croise  

I bilive and trust sey God go protet mi. So wetin make yu dey sey, “Fly like bird go hide for mountin, so dat yu go dey save,


Just as di plenty sojas wey king get nor go fit save am, na so too pesin pawa nor go fit save am.


I don still notis anoda tin for dis world sey; nor bi who run pass dey always win di race and nor bi di sojas wey strong pass, dey always win di war. Wise pipol dey hongry sometaims and just as pipol wey dey work hard nor dey always get money, na so too pipol wey know book nor dey always get betta life. All dis tins dey happen by shance, as long as yu dey di rite place for di rite time.


Assyria king sey, “Na mi win all dis nashons by mysef. I strong well-well, wise and get sense. I skata nashons boundary kon karry all dia propaty. Na with my strong hand and pawa I take distroy strong rulers and kings.


Bikos of dis, Oga God wey get pawa go ponish en pipol with sickness. Yes! En glory go-go up like smoke.


Judah pipol sey, “Wi don hear how Moab pipol dey karry body up. Wi know sey di pipol sturbon well-well, but na empty mout dem just dey make.”


Una pride don deceive una. Nobody dey fear una as una tink. Una dey stay for rock and on-top mountin a nd even doh una house high like eagle own, God go bring una kom down.” Dis na wetin Oga God tok.


How una go sey, ‘Wi wise well-well and wi know God law, wen e bi sey, doz wey dey tish di law, don shange wetin e really mean?’


God sey, “Make wise pipol nor dey boast, bikos dem wise and make doz wey strong, nor boast sey dem get pawa. Make doz wey get money, nor boast with di money wey dem get.


God sey, “From Migdol town for nort go rish Aswan town for sout, evribody wey dey guide Egypt, go die finish for di war. Di sojas wey dey make Egypt proud, dem go distroy all of dem.” Mi, God wey get pawa, don tok.


Na di reward for dia pride bi dat, bikos dem don curse di pipol wey bi Oga God own.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan