Abner koll Joab kon sey, “Na so wi go dey fight forever? Yu nor dey si sey wi nor go gain anytin, apart from wahala? Wi bi yor kountry pipol. Wen yu go tell yor men make dem stop to porshu us?”
But God sey, “Axe go fit sey e big pass di man wey dey use am? Abi cutlass dey important pass pesin wey dey use am kut sometin? Nor bi gun dey karry pesin wey hold am, but na di pesin dey karry am.”
Na how long awa land and di grass for di farm go dey dry? Awa animals and birds dey die, bikos of dis pipol wikedness! Pipol wey sey, ‘God nor dey si wetin wi dey do.’ ”
“ ‘Mi, wey bi God sey, “I go ponish dem for four difren ways: I go make dem die for war. I go allow dog karry dia dead body. I go allow birds and wiked animals chop dia flesh
Den God tell mi, “Tell di pipol sey mi, Israel God wey dey mighty, dey kommand dem make dem drink till di drink katch dem. Dem go dey vomit until dem fall for groun and dem nor go fit get up again, bikos I dey send war kom meet dem.
den di oda group, do di same tin too. All of dem hold dia tosh for dia left hand, while di trumpet dey dia rite hand and dem kon shaut, “One swod for God and for Gideon!”