Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 46:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Israel God still sey, “I go ponish Amon; Tebes god; Egypt with en gods and kings. I go karry Egypt king with doz wey trust am

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 46:25
16 Iomraidhean Croise  

Dat same nite, I go pass thru Egypt kon kill all di first-born son inside Egypt, both human being and animals, den I go judge all di gods for Egypt. Na mi bi di Oga una God.


Dis message na about Egypt: Si, God dey ride on-top di kloud kom Egypt. Egypt juju fear wen dem si am and di pipol heart kon fail dem.


Just as I give Zedekaya for Judah to King Nebukadnezzar for Babilon, na so too I go give King Hofra for Egypt to en enemies.’ ”


Heshbon pipol, make una kry, bikos dem don distroy Ai! Rabbah wimen, make una wear sak klot kon mourn. Make una dey konfuse, bikos dem go karry una god, Molek with en priests and princess, go anoda kountry.


Naw, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok: ‘I bi Egypt pipol enemy. I go break di king two hand; both di one wey good and di one wey don break before, den en swod go fall for groun.


God go make dem fear as E dey distroy all di gods for di land.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan