Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 46:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Dis na wetin E tok about Egypt and King Neko sojas for Egypt, wey King Nebukadnezzar for Babilon win for Karkemish near Eufrates River for di fourt year wen Jehoiakim bi king for Judah.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 46:2
16 Iomraidhean Croise  

Si, yu really dey bilive sey Egypt pipol go kom help yu? Egypt wey bi like shuku-shuku; if pesin won rest put, e go wound di pesin hand. Dat na wetin King Fero for Egypt dey do to evribody wey dey trust am.


Wen King Josaya still dey rule, Fero Neko wey bi Egypt king with en men kon go River Eufrates go support Assyria king for war. King Josaya and en men go fight dem, but wen King Neko si am for Megiddo, e kon kill-am.


Fero Neko katch am put for prison for Riblah wey dey Hamat land, so dat e nor go fit rule Jerusalem pipol. Neko sey make di pipol for di land pay am 7,500 pound for silva and 75 pound for gold.


Egypt king with en men nor komot from dia land again go fight, bikos Babilon king don konker evriwhere wey Egypt king bin get before from Egypt wotaside go rish Eufrates River.


I don win Kalno, Karkemish, Hamat and Arpad towns. Yes, I still win Samaria and Damaskus pipol.


Dis message na about Egypt: Si, God dey ride on-top di kloud kom Egypt. Egypt juju fear wen dem si am and di pipol heart kon fail dem.


For dat time, dem go build one altar for God for di middle for Egypt, with one holy pila wey dem go dedikate give God for Egypt boundary.


For di fourt year wey Jehoiakim, Josaya pikin bi king for Judah, God tok to Jeremaya about all di pipol for Judah. (Dis na di first year wey Nebukadnezzar dey rule for Babilon.)


Dis na di oda pipol wey drink from di cup: King Fero for Egypt; doz wey dey serve am; en ofisas, en pipol;


‘I go koll di pipol wey dey nort and my savant King Nebukadnezzar for Babilon and dem go kom fight against Judah pipol and di towns wey dey round Jerusalem. I go distroy and skata dis nashon and di ones wey dey round am, forever. I go make pipol si and dey fear dem.


For di fourt year wey Josaya pikin, Jehoiakim bi king for Judah, God kon tell mi:


Nebukadnezzar go kom win Egypt. Di pipol wey I don sey diziz go kill, na diziz go kill dem; doz wey dem go karry go as prisonas, dem go karry dem go and doz wey dem go kill for war, go die for war.


For di fourt year wey Josaya pikin, Jehoiakim bi king for Judah, Baruk wey bi Neraya pikin, rite evritin wey I tell am. So I sey,


“Make yu shaut am for Egypt, Migdol, Memfis and Tahpanhes sey, ‘Make una ready to defend unasef, bikos dem go kom fight and distroy evritin where una get!’


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan