Assyria king go karry Egypt and Ethiopia pipol go as prisonas. Weda dem yong or old, dem go waka naked with ordinary leg and dia yansh go dey open and e go bi shame for Egypt pipol.
Wetin make yu dey tok all dis foolish tins with God name? Wetin make yu dey tok with en name sey, ‘Dem go distroy dis temple, just as dem distroy Shiloh and nobody go dey here again.’ ” Den all di pipol kon gada round mi.
Bikos mi God don sey, I go orda dem and dem go kom di town again. Dem go attack, seize and burn am rish groun. I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.’ ”
“Make yu shaut am for Egypt, Migdol, Memfis and Tahpanhes sey, ‘Make una ready to defend unasef, bikos dem go kom fight and distroy evritin where una get!’
Yu wey dey stay for Dibon, kom down from yor place where honor dey kon sidan for san-san; bikos di pesin wey distroy Moab and skata en strong-strong buildings, go distroy una too.
I go make sure sey na Egypt land empty pass for di world. For forty years, Egypt towns go skata. Yes! E go skata pass any oda place. I go make Egypt pipol bi strenjas and dem go dey look for where dem go stay. Dem go run go difren kountries kon stay with strenjas.”
Even if dem eskape distroshon for Assyria, Egypt sojas go kill dem and Memfis pipol go beri dem. Grass and shuku-shuku go grow kover all di place where dia house and silva dey.
Curse dey Filistia pipol head wey dey near di river and doz wey dey Kanaan land, bikos dis judgement na against una two! God go distroy all of una finish.