Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 46:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 For der, dem go sey, ‘Make una give Egypt king new name, bikos e too make nois and na dis make am miss all en shance.’

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 46:17
11 Iomraidhean Croise  

from Ben-Hadad sey, “I go bring men kom distroy dis yor town and dem go use dia hand karry all di good tins komot. Make di gods kill mi, if I nor do am.”


Ahab ansa, “Make una tell King Ben-Hadad sey, ‘Betta soja nor dey make mout until e fight en war finish.’ ”


Den e give orda sey, “Make una kill dem, weda dem dey kom fight or make peace.”


But Yu breath from yor nose and di sea swallow dem. Dem sink like stone inside di big sea.


Di enemies sey, ‘I go porshu, katch, divide dia propaty kon take evritin wey I wont. I go distroy dem with my swod.’


Evritin wey dey happen for dis world, dey happen for di rite time wey God wont make e happen.


Egypt pipol nor bi god! Dem bi ordinary human being. Dia horse na just flesh nor bi spirit! God go distroy dem with en hand. Di pipol wey dey help dem, go stagga and di ones wey dem dey help, go fall for groun and all of dem go die togeda.


Tell am sey dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Yu wey bi juju for wota, I bi yor enemy naw. Yu sey na yu get and kreate Nile River abi?


Na Egypt king and en pipol bi di tree. E get any tree for Eden wey tall and fine like una? But naw, like di trees for Eden, una go die kon join wiked pipol and doz wey dem kill for war. Dis na wetin Oga God tok.’ ”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan