Even di sojas wey dem hire lazy like small goat. Instead make dem stand fight, na run dem dey run. Di day for dem to face wahala and ponishment, don kom.
Make una kill all di farmer wey dey plant for di town. Make all di strenjas go back to dia own pipol. Make dem rush go back to dia land, so dat doz wey dey attack, nor go kill dem join Babilon pipol.”
Strenjas for der sey, ‘Wi bin won kom help Babilon town, but e don too late. Make wi leave am kon go back to awa house, bikos God don ponish Babilon pipol kon distroy di town.’ ”