Jeremaya 46:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
14 “Make yu shaut am for Egypt, Migdol, Memfis and Tahpanhes sey, ‘Make una ready to defend unasef, bikos dem go kom fight and distroy evritin where una get!’
Abner koll Joab kon sey, “Na so wi go dey fight forever? Yu nor dey si sey wi nor go gain anytin, apart from wahala? Wi bi yor kountry pipol. Wen yu go tell yor men make dem stop to porshu us?”
“Dem go kill Assyria pipol with swod for war and nor bi swod wey human being make. Assyria pipol go run from di swod and dem go turn dia yong men to slaves.
Na dia blood and flesh full God swod like sey na lamb, goat or animal wey dem take do sakrifice. God go do dis sakrifice for Bozrah town and E go kill Edom pipol well-well for di land.
“Even as I ponish una shidren rish, dem nor gri shange or listin as I dey korrect dem. Just as lion dey kill en enemy, na so too una don kill una profets finish.”
Na God wey dey mighty get today. Today, E go take revensh kon ponish all en enemies. En swod go kill all of dem. God wey dey mighty don sakrifice doz wey fall for en trap for di nort side for Eufrates River.
Dis na wetin E tok about Egypt and King Neko sojas for Egypt, wey King Nebukadnezzar for Babilon win for Karkemish near Eufrates River for di fourt year wen Jehoiakim bi king for Judah.
“Man pikin, make yu profesai. Tell dem wetin mi God wey get pawa dey tell Ammon pipol wey dey curse Israel. Tell dem sey: “ ‘One swod dey ready to skata; swod wey dem polish to kill and e dey shine like tonda lite.
Even if dem eskape distroshon for Assyria, Egypt sojas go kill dem and Memfis pipol go beri dem. Grass and shuku-shuku go grow kover all di place where dia house and silva dey.
But Oga God wey dey lead Heaven Sojas sey, “Nineveh pipol, I bi una enemy! I go burn una shariot kon kill una yong men for war. Evritin wey una take from oda nashons, I go take dem from una hand and nobody go hear una messenjas vois again.”